Trending

Monday, December 7, 2015

Patience vs Dasuki


CONVERSATION BETWEEN COL. SAMBO DASUKI AND DAME PATIENCE JONATHAN

Dasuki: Grin Grin Grin (phone rings)

Patient Jonathan: Hello, nah who be dat?

Dasuki: Your Excellency sir, good morning.

Patient Jonathan: No be oga dey talk, na me Mama Peace dey talk.

Dasuki: Sorry ma, good morning ma. Na Dasuki dey call ma.

Patient Jonathan: ehn, Morring. Wetin you want?

Dasuki: Dem don arrest me.

Patient Jonathan: Wetin you do?

Dasuki: Dem say I steal $2.1B money meant for ammunition for our soldiers.

Patient Jonathan: Na true?

Dasuki: em em em, I am...

Patient Jonathan: kip kwayeti, na only you waka come?

Dasuki: No be only me o. Dokpesi dey o.

Patient Jonathan: Shey dat AIT man? Wetin him do again?

Dasuki: Him sef get N2.1B from the money.

Patient Jonathan: God catch am!

Dasuki: Bafarawa sef dey here o

Patient Jonathan: Ah ha, Batagata gini? who be dat? wetin him do?

Dasuki: Na our Chief Imam o. Na him collect N4.2B to take organise all the imams for nijiria wey pray for oga for second term o.

Patient Jonathan: Shey we win? No be fake prayer dem do?

Dasuki: I no know ma.

Patient Jonathan: Issorait. shey na all of una dem don carry?

Dasuki: No o, na only three of us.

Patient Jonathan: Three of una, Oritsejafor nko?

Dasuki: Dem never arrest am.

Patient Jonathan: Wat of my father-in-law, Edwin Clarke?

Dasuki: Dem never catch am ma.

Patient Jonathan: Orubebe nko?

Dasuki: E no dey with us but him dey face different trial.

Patient Jonathan: uhm, uhm dis man nko? Okpepe abi wetin dem call am?

Dasuki: Okupe ma. him never join us.

Patient Jonathan: E good like dat. Na so una deceive my husband. God don catch una. My husband no dey o. No call this number again o. (Gbam, phone drop).

Patient Jonathan: (Sitting and thinking), eewo! eewo!!! eewo!!! dis people don kill Nijiria o. Ah, Dia ris God o. Dia ris God o.

Na somebody dream I share oooooo!

- Sunday Akoji